Joke of the Day!!
* Akpos : Papa, See my result, Na me carry
3rd.
Papa Akpos : Hahahahhaha,
* Akpos Akpos! Na now I know say na me born
you. Like father like son.
* Akpos : Shey I tell you na. All those time i
dey carry 35th, 39th.. Na the teachers dey do
ojoro, they know say i too de brilliant.
* Papa Akpos : I believe you my boy. Na now I
fit buy that Bicycle wey you see for Papa
Metus shop!
* Akpos : Papa na u biko. You get mouth pass
BasketMouth.
Papa akpos : but, Who be the two idiots wey
pass u sef Akpos?
* Akpos : Na one LIZARD wey be Ekaette and
one MONKEY wey be Patience.
* Papa akpos : No mind them, You go show
them next term.
But who you come pass na? I know say dem
plenty and you no fit mention all of them, I
just wan know how many of una dey class
* Akpos : Na just the 3 of us I don mention so
na… Ekaette, Patience and Me.
Na just the 3 of us PRINCIPAL put for
Elementary Class ‘F’ !!!
* Akpos Papa still dey for Comma at general
Hospital…
You can share this on your facebook page with
the facebook share button above, make
someone else smile. For mtn cheats visit mtnpulsecheat.blogspot.com
the no.1 place where you'll find Hilarious jokes , worldwide gossip,news and gist *wink*
Friday, 18 October 2013
BRILLIANT AKPOS
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment